So far, 20 pipo don share ova $4m in rewards afta dem find $40m of di stolen money and call di crypto companies make dem block di transfer.
But sabi pipo no dey optimistic again say dem go fit recover di rest of di money becos of di North Korean knowledge for hacking and laundering of di money.
Dr Dorit Dor from cyber security company Check Point tok say, “North Korea na veri closed system and closed economy so dem don create successful industry of hacking and laundering and dem no care about di negative impression of cyber crime”